Friday 7 June 2013

For Naija Language

E don reach time wey we, as original Naija people go stop to dey use oyinbo abreviations like LoL, LMAO, ROTFLMAO etc .
when we fit dey use our own exceptional Street lingua. For example:
LWKM - Laugh wan kill me
MIDG - make i dey go
WGYL - we go yarn later
IGA - I gbadun am
ICS - I can't shout
DJM - Don't jealous me
WBDM - Who born d maga
UDC - U de craze
NUS - Na u sabi
WSU - who send u
ITK - I too know
WDH - wetin dey happen
NDH - nutin dey happen
FMJ - free me jo
BBP - bad bele people
HUD - how u dey
WKP - waka pass
NTT - Na true talk
NDM - no dull me
IFSA - I for slap am
IGDO - I go die o
YB - Yess boss
NLT - No long thing
CWJ - carry waka jorh
WBYO - wetin be your own
U2D - U 2 do
U2DV - U 2 dey vex
WSDP - who send dem papa
INS - i no send
INFS - i no fit shout
WWY - who wan yarn
NBST - no be small thing
NWO - na wah oooooo
NMA - no mind am
MIHW - make i hear word
NDY_ nothing do you....(y)
YTDL_you too dey lie
YGM- you get mouth
YHDT- your head d̶̲̥̅̊ε̲̣̣̣̥γ̲̣̣̥ there
oya mk una cram am Äπϑ begin apply am o:D


oya laff and DYC it-drop your comment

No comments:

Post a Comment